Nigeria vs Algeria: Super Falcons Draw in WAFCON 2024 Group Stage
Di Super Falcons of Nigeria draw against Algeria for dia final group stage match for di Women's Africa Cup of Nations (WAFCON) 2024. Di match wey happun for Casablanca end 0-0, even though Nigeria bin already qualify for di quarterfinals.
Match Highlights
Di match bin dey competitive, with both teams dey fight hard. Nigeria get plenty chances to score, but di Algerian defence bin strong and dia goalkeeper bin dey sharp. For di second half, Nigeria try different substitutions to break di deadlock, but e no work.
- 87': Echegini miss chance for Nigeria after she dribble players from outside di goal area, she fire shot but e go corner of di goal post.
- 83': Nigeria still dey try to break di Algerian defence as Ijamilisu strike but Algeria goalkeeper save am.
- 58’: Echegini of Nigeria dribble players outside do box sotay she enta di box but di shot no enta net.
- 55’: Rasheedat Ajibade of Nigeria make good run into Algeria area but defenders push her fall. Refree blow corner kick, dem play am but notin come out.
What Dis Mean For Nigeria?
Even though di Super Falcons no win di match, dem still top dia group and qualify for di quarterfinals. Coach Justin Madugu bin talk say di match na opportunity to improve di team and try different tactics. E make changes to di team, but di goal still remain to win.
Algeria Performance
Algeria show strong defence against di Super Falcons. Coach Farid Benstiti bin talk say di match na test of character and discipline for his team. Even though dem no qualify for di next round, dem show say dem dey improve and dey ready to fight.
Di WAFCON 2024 dey continue, and we dey expect more exciting matches as di tournament dey progress.